Caf Awards 2023: Victor Osimhen, Asisat Oshoala, Chiamaka Nnadozie emerge win big for Africa footbal
11 December 2023New Informate 12 December 2023
Nigeria win big for di 2023 edition of di Caf awards.
Di awards wey hold for Morocco on Monday night see Super Eagles player Victor Osimhen win di best footballer of di year for Africa – for di men’s category.
Di Napoli forward beat PSG right back Achraf Hakimi of Morocco and Mo Salah of Egypt and Liverpool to win di award for di first time.
Osimhen join oda Nigerians including Rashidi Yekini, Emmanuel Amunike, Nwankwo Kanu and odas to win di award.
For di women category Asisat Oshoala make history as di first woman to win di award for record six times.
Super Falcons goalkeeper Chiamaka Nnadozie also win di best Goalkeeper award for Africa for di women category.
Assisat Oshoala record go hard to break?

Many pipo no surprise wen dem call Asisat Oshoala name as di winner of di Africa Women’s Player of the Year, di award na for di best footballer for Africa for 2022-23 season.
Di attacker performance ginger Barcelona to Champions League glory, she finish as di club top scorer wit 27 goals across all competitions.
Oshoala help Nigeria reach di quarter finals of Women’s World Cup and .
‘’E easy to call her di greatest based on her numbers, statistics and records’’. Football sabi pesin Fisayo Dairo tok.
‘’Oshoala record sixth CAF African Women’s Player of the Year Award go hard to break,’’ Dairo add.
‘’To win di award six times wen you no be Lionel Messi or Cristiano Ronaldo no be child's play’’.
Dairo say e go take time for pesin to break Oshola record.
E go take a talented player, perhaps di African version of Linda Caicedo (of Colombia) to break am. She go need to start early like Oshoala.
“Today na Nigeria night. Dis na di first time ever wey two Nigerians collect award as African Player of the Year for women and men categories. E dey massive. I dey so happy for Asisat [Oshoala] and Victor [Osimhen], na wetin Mercy Akide, wey win di first edition for 2001 tok.
“Asisat bin dey exceptional all year round for both kontri and club level for Barcelona and to see CAF award her, e mean so much to us as a kontri. Nigeria – we be winners so dis na big day for us.”
Four-time winner Perpetua Nkwocha wey win di award for (2004, 2005, 2010 and 2011) from Nigeria say, “Asisat dey exceptional and for her to win tonight mean a lot to her and us as a kontri. Dis go motivate her to continue to work hard.”
Many pipo see Nkwocha and Akide, as pioneers for di growth of Women Football for Nigeria and on di continent, she add say dis go further promote di growth of di game back home and across di continent.
Akide bin win di Women’s Africa Cup of Nations wit Nigeria for 1998, 2000 and 2002 while Nkwocha win di continent biggest tournament wit Akide for 2002 before she inspire di Super Falcons upfront for 2004, 2006, 2010 and 2014.

Players wey don win Caf awards bifor
Na Sadio Mane and Asisat Oshoala be di reigning winners of di award.
Dis na list of women wey don win di award so far;
2001 Mercy Akide (Nigeria), 2002 Alberta Sackey (Ghana) , 2003 Adjoa Bayor (Ghana), 2004 Perpetua Nkwocha (Nigeria), 2005 Perpetua Nkwocha (Nigeria), 2006 Cynthia Uwak (Nigeria), 2007 Cynthia Uwak (Nigeria), 2008 Noko Matlou (South Africa), 2010 Perpetua Nkwocha (Nigeria), 2011 Perpetua Nkwocha (Nigeria) and 2012 Genoveva Anonmam (Equatorial Guinea).
Odas na 2014 Asisat Oshoala (Nigeria), 2015 Gaëlle Enganamouit (Cameroon), 2016 Asisat Oshoala (Nigeria), 2017 Asisat Oshoala (Nigeria), 2018 Thembi Kgatlana (South Africa), 2019 Asisat Oshoala (Nigeria) 2022 Asisat Oshoala (Nigeria).
Di award no hold for 2009, 2019, 2020 and 2021
Pipo wey don win di awards for di Men’s category before na;
1992 Abedi Ayew Pele (Ghana), 1993 Rashidi Yekini (Nigeria), 1994 Emmanuel Amunike (Nigeria), 1995 George Weah (Liberia), 1996 Nwankwo Kanu (Nigeria), 1997 Victor Ikpeba (Nigeria), 1998 Mustapha Hadji (Morocco), 1999 Nwankwo Kanu (Nigeria), 2000 Patrick Mboma (Cameroon), 2001 El-Hadji Diouf (Senegal), 2002 El Hadji Diouf (Senegal), 2003 Samuel Eto’o (Cameroon), 2004 Samuel Eto’o (Cameroon), 2005 Samuel Eto’o (Cameroon), and 2006 Didier Drogba (Côte d’Ivoire).
Odas na 2007 Frederic Kanoute (Mali), 2008 Emmanuel Adebayor (Togo), 2009 Didier Drogba (Côte d’Ivoire), 2010 Samuel Eto’o (Cameroon), 2011 Yaya Toure (Côte d’Ivoire), 2012 Yaya Toure (Côte d’Ivoire), 2013 Yaya Toure (Côte d’Ivoire), 2014 Yaya Toure (Côte d’Ivoire), 2015 Pierre-Emerick Aubameyang (Gabon), and 2016 Riyad Mahrez (Algeria),
Di remaining pipo na 2017 Mohamed Salah (Egypt), 2018 Mohamed Salah (Egypt), and 2019 Sadio Mane (Senegal), 2022 Sadio Mane (Senegal).
CAF Awards 2023 photos






ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmmqqknrCtsdJomqmvoJmyeMLWsrCo